Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don rescue everybody wey involve for di serious askident wey happen for Otedola Bridge, inward Berger, on Wednesday afternoon, as nobody kpai for di askident.
Na two trucks, one trailer, one white Honda car and one Lexus dey involved for di askident as initial check show say one container truck develop mechanical problem as e dey move, di driver kon lose control, jam three other motor, na so another truck later jam all of dem together.
LASEMA quickly respond and take charge of di rescue operation together with LASTMA and Police.
After dem rescue di victims, LASEMA paramedics sharpaly give di victims first treatment for di scene before dem carry dem go Trauma Centre for further treatment.