Politics

Obi Explain Why E Go Benue After Thugs Attack Him Convoy

todaySeptember 8, 2026 3

Background
share close

By: Ayobami Dada

NDC presidential candidate, Peter Obi, don tok say e go Benue no be for campaign, but to visit people wey recent killings affect and show dem sympathy.

Obi tok dis after suspected thugs block and attack hin convoy as e dey enter Benue.

E say, “I dey Benue today no be for campaign. I just wan go where people lose their lives, condole with dem and show solidarity.”

Obi say wetin happun show how Nigerian politics don dey deteriorate, as e call on politicians to embrace unity, love and justice.

E add say Naija na everybody own, and Nigerians must work together to build the country.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds