Entertainment

Olu Jacobs Family Announce Funeral Plans

todaySeptember 24, 2026 6

Background
share close

Family of veteran Naija actor, Oludotun Baiyewun Jacobs, wey everybody know as Olu Jacobs, don announce plans for im burial, as Night of Tributes go hold for Lagos on September 30, 2026.

Im wife, veteran actress Joke Silva, sign di letter on behalf of di family and send am to Presido Bola Tinubu, as she thank am for di condolence message after Olu Jacobs kpai.

Joke Silva say di family appreciate Tinubu for im support and concern following di death of di veteran actor.

Di Night of Tributes go hold on Wednesday, September 30, by 4 p.m. for Glover Memorial Hall, 19 Marina Road, Lagos Island, and di dress code na shades of blue.

Di Funeral Service go follow on Friday, October 2, 2026, by 10 a.m. for This Present House, Freedom Way, Lekki Phase 1, Lagos, and di dress code for di funeral service na shades of green.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds