By: Yusuf Abuh
Oyo State Government don promise say security pipo dey work well-well to save di school children and teachers wey bandits kidnap for inside Oriire Local Government since May 15.
Di government tell di families say dem feel dia pain, and dem dey stand with dem as operation dey go on to bring di victims back safely.
Reports show say di bad pipo carry dem go inside Old Oyo National Park forest, and dem don already kill one teacher and one okada rider since di wahaala start.
Even though di victims don spend pass 30 days for captivity, government assure say army, police, and Amotekun nor go rest until dem free everyone and catch di kidnappers.