Lagos

Police Gbab 4 Suspected Cultist For Lekki, Ajah Area

todayOctober 13, 2026 7

Background
share close

Lagos State Police Command  don do small Rambo go kramp  four suspected cultists jaguda boys, say dem bin dey do jaguda doings for  Lekki, Ajah and Elemoro area.

According by statement wey police tok tok pesin, Adebisi Abimbola release say dem arrest one Arisekola Ojo, Oluwatobi Oyewole, Oluwaseyi Odunewu and Olumagba Ifatope.

Abimbola konfamate say police nor be winch say na information wey di suspects by diasef give during di touchlighting dem take recover one locally made short gun for Oluwaseyi house, kon catch oda suspect.

Lagos State Commissioner of Police, Tijani Fatai, fry mouth say police go continue to fight cultism and oda crime for Lagos, as hin dey warn jaguda boys to repent.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds