Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
The Edo State Police Command don talk say heavy security patrol wey dem put for major highways don lead to the rescue of one kidnap victim and also stop another abduction attempt. For one statement wey dem release on Sunday, the Command spokesperson, SP Moses Yamu, talk say police officers successfully rescue Elohor Osifoh, wey kidnappers carry on September 10. He talk say dem free the victim after “days of serious bush-combing rescue operations”, and she don reunite with her family. Yamu still talk say for another separate operation, police foil attempt to kidnap three travellers along the Benin–Lagos Expressway for the early morning of September 13. He talk say, “Around 02:30hrs, police officers from Okada Division, led by CSP Opatoyinbo John, dey do routine patrol for Morgan and Isiuwa slope when dem quickly respond to one distress call about kidnapping attempt.”
According to am, the kidnappers don block road with log of wood and shoot at one Toyota Sienna with plate number KUJ 342 CU, wey Nana Aghogho, 51 years old, dey drive. The man dey carry fingerling fish from Lagos go Akwa Ibom. Two other people, Oseghale Mathias and John Edobor follow dey inside the motor. Police officers engage the gunmen for shootout, and as the pressure hot, the criminals abandon their plan and run enter nearby forest. “The driver and the two passengers dem rescue without injury. The logs wey the criminals use block road dem quickly remove am, restore normal traffic, and make sure say other road users safe,” Yamu add. Commissioner of Police, Monday Agbonika, hail the quick response of the police team and beg the public make dem dey alert and report any suspicious movement. He also assure say the Command dey ready to flush out all criminals from highways across Edo State.
Written by: News Editor 2
ABDUCTION KIDNAP RESCUE LAGOS BENIN ROAD ROAD SAFETY
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025