Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don cancel im Ogun trip wey suppose happen on Wednesday, make im first waka go Jos, Plateau State, to feel with victims of di gbege wey kpai at least 27 pipo for Angwan Rukuba district on Sunday.
Na Special Adviser to di Presido on Informate and Strategy, Bayo Onanuga, talk am for statement wey im sign on Wednesday.
Di move come after Tinubu and Plateau State Govo, Caleb Mutfwang meet for Aso Rock Villa on Wednesday evening, as di govo dey yarn am how security marras dey for di state.
But presido Tinubu go travel to Jos today to console di gornment and pipo of Plateau over di recent jaguda doings for Angwan Rukuba, Jos North.
Written by: Ridwan Agbomeji
BOLA AHMED TINUBU caleb mutfwang JOS OGUN STATE
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026