By : Jolayemi Olajide
Presido Bola Tinubu don explain how di economic reforms wey gornment dey carry out go help make things cheaper for Nigerians.
Tinubu tok dis one for im Independence Day address on Thursday as Nigeria dey celebrate 66 years of independence.
E say government go cut di cost of living by reducing how much e dey cost to produce food and other goods, plus di money wey dem dey spend to move dem from one place to another.
E also say gornment go improve irrigation, make seeds and fertilizer easier for farmers to get, bring more machines into farming and invest for better storage and transportation.