By: Yusuf Abuh
Wi oga Presido Bola Tinubu don officially flag off di reconstruction of di 122-kilometre Kaduna–Birnin Gwari Road through Gofnor Uba Sani, say now wey im dey deliver im 2022 campaign promise, nobody dey tuk oh.
Tinubu tok say na based on im coconut head im take package dis project, dat security pipo warn am about di Birnin Gwari, say kidnappers oh, im say no, my pipo dere now.
Say na so im put call to di Federal Executive Council and na so dem take approve ₦178.12 billion for di project because di road na major link between North-West and South-West reach Lagos.
Gofnor Uba Sani praise Tinubu and Works Minister Dave Umahi for di approval, add say Kaduna State gornment dey happi wetin nor gud for dis project.