OBODO NAIJA

Protest, Petition Rock APC Cause of Some Failed Screening

todayMay 13, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Say nor be small gbege for All progressives Congress, dat many aspirants dey complain about di party screening ahead of 2027 election.

For states like Kano, Rivers, Kaduna, Benue and Kogi, angry politicians don begin submit petitions and threaten court case over how di process go.

Di screening normally na to reduce di number of pipo wey wan contest before party primary, but many dey vex for di outcome.

Some aspirants even say party leaders dey try impose candidates through consensus instead of allowing fair competition.

For some places, supporters don already dey protest, while party members dey warn say di matter fit cause serious division inside APC.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds