By : Jolayemi Olajide
Some Lagos pipo storm State House of Assembly on Monday to protest because police lock up one Ajiran community leader, Hammed Tajudeen Akanbi.
Di protesters march from Ikeja Shopping Mall go give di Speaker petition, as dem dey shout make gornment release di man.
Dis rally hapun after Akanbi lawyers cry out say di court dey do partial for the mata, so fresh investigation must start.
Dem lock the leader put for jail because dem allege say im follow get hand inside the death of two pipo for Eti-Os