By: Esther Ayoola
Chelsea coach Liam Rosenior don clear rumor wey dey fly say Cole Palmer wan go back Manchester, say di boy happy well-well for Chelsea.
Rosenior say e don tuk face-to-face with Palmer afta di gist, and Palmer confirm say e no get any plan to waka.
According to Fabrizio Romano, Rosenior tuk say Palmer na big part of Chelsea long-term plan and dem no fit lose am for anything.