Govo Babajide Sanwo-Olu on Wednesday dey beg Lagos lawmakers say make dem continue to support am so dat e go finish all di projects and reforms wey dey ground before im tenure end.
Im talk dis one for di 19th Executive–Legislative Parley wey hold for Eko Hotels and Suites, Lagos.
Di govo emphasize say make executive and Lagos House of Assembly continue to work hand-in-hand so dem fit deliver on top im THEMES+ agenda.
Sanwo-Olu sti hail Speaker Mudashiru Obasa and Assembly members, say since 2019 dem don dey run better partnership wey don help push big infrastructure and policy work for Lagos.