By : Jolayemi Olajide
Di National Leader of Nigeria Democratic Congress, Senator Seriake Dickson, don beg all the aspirants wey dey vex because of the scatter-scatter wey hapun for their recent primary elections.
Dickson yarn dis one for TV down, say he know say di arrangement no too hold water, but make dem chillax, say na for di greater good of all.
E explain to di once wey dey vex say make dem try understand, because NDC na new party wey just start and the time dem get to arrange everything too small.