Director of Strategic Communication for ADC Presidential candidate Atiku Abubakar, Phrank Shaibu, don tok say any gornment wey no put pipo lives first nor be gornment at all, na jaguda boys dem be.
E drop dis hot word for one television siddon tok on Monday, November 16, 2026, to defend Atiku promise say e go bring back fuel and light subsidy.
Shaibu press mouth say Atiku wan reduce di heavy market wahala wey dey press common man for neck.
E warn say true gornment suppose helep pipo chop bellefull, no be to dey watch dem suffer like market fowl for sun.