Soldiers under Operation FANSAN YAMMA don burst one secret gun factory for Kebbi State, recover five locally-made AK-47 rifles, and grab two suspected gun makers wey dey supply terrorists with weapons.
Confirming di operation for inside statement on Thursday, di Media Information Officer of Operation FANSAN YAMMA, Lt. Col. Aliyu Danja, tok say di soldiers plan well well before di operation.
According to di military, na correct intelligence make dem trace di hidden compound wey di suspects turn to workshop to forge guns.
Danja sti add say, other security agencies join hand with di soldiers for di operation, saying na another heavy blow against terrorists for di North West