Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Super Eagles no fit collect full three points for South Africa as dem play for Bloemfontein, and now Nigeria 2026 World Cup hope dey hang for thin rope. Wahala burst as Super Eagles captain Troost-Ekong knack own goal, but Calvin Bassey show face sharp-sharp with one strong equaliser, as Nigeria manage drag 1-1 draw with South Africa for hot 2026 World Cup qualifier wey happen Tuesday for Bloemfontein. With just two games remain for the group stage, Nigeria dey 6 points behind South Africa wey dey top Group C with 17 points. Super Eagles dey manage 11 points, same with Benin Republic wey still get one match for hand. From the first whistle, South Africa rush come like lion wey never chop, press Nigeria anyhow, as dem wan use home advantage scatter ground early. Nigeria begin show sign for 10th minute as Ademola Lookman tear ground with better cross from right wing, wey give Super Eagles corner. But South Africa keeper, Foster, no sleep the guy nack quick header comot the danger sharp-sharp.
Na for 25th minute wey gbege land. Wahala gas as Nigeria captain William Troost-Ekong mistakenly knock ball enter hin own net own goal wey just dash Bafana Bafana the lead. Everywhere shock,But Naija no gree fall. Just before half-time, dem answer back with fire. Calvin Bassey climb like electric pole, nod one powerful and somehow controversial header wey tear net straight! 1-1! The whole stadium just freeze, Naija fans shout, South Africa quiet like graveyard. As dem blow whistle for halftime, Nigeria shuffle things with two bold changes wey show say dem no come play. Arokodare enter for Dessers, while Onyemaechi replace Troost-Ekong wey no too shine for first half. Arokodare no waste time at all the guy catch fire quick! He tear down the left wing like say na express road, cut inside with better control, then release one wicked shot wey just waka pass post small. Second half begin, and slowly-slowly, Naija begin hold ground. Ball dey Nigeria leg steady as dem start to press, dey dominate play. But South Africa no gree die dem still hold body, dey defend with lion heart. For dying minutes, Nigeria carry everything go front attack full blast, everybody push forward dey find that winning goal. But that second goal na just wahala e no gree show face. Opportunity waste, and as final whistle blow, e be like cold water pour for body. That small chance wey remain to qualify don almost waka. Even with all the late ginger, Super Eagles still no fit find net again. The second goal wey dem need pass dem, and now, Naija World Cup hope dey dangle like last bus for hold-up.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025