Gofnor Lucky Aiyedatiwa of Ondo State don clear matas say all the South-West gofnor dem dey join bodi work to secure the region.
Di gofnor yarn dis one on Wednesday after one High Court for Abuja jail four pipo wey get hand for di bad attack wey happen for St. Francis Catholic Church inside Owo town back for 2022.
Aiyedatiwa explain say, di govos even meet for Ibadan inside Oyo State to plan how dem go take use dia local security group wey be Amotekun protect di area.
Dis plan dey come as tension dey high for diSouth-West area after bad pipo go kidnap some teachers and students for Oyo State and do another kidnap for Ekiti State.