Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos
todayOctober 17, 2025 8
Former Speaker of Lagos State House of Assembly, Adeyemi Ikuforiji don talk say Nigerians suppose hold state governors and local government chairmen responsible for governance, instead of always blaming di federal government. As e talk for him office for Lagos dis week, Ikuforiji point say state and LGs dey collect over 50% of federal allocation, yet citizens no dey hold dem to account. E say people get better access to their local council chairmen pass President, so accountability suppose start from there. E say e dey always shameful when governors dey commission small projects like 4 or 5 classrooms – say na work for LG chairmen be that. Ikuforiji blast Houses of Assembly across Nigeria say dem too weak and dey act like “aprons around governors waist” instead of checking executive power, unlike Lagos where since 1999, di Assembly dey always hold governors accountable.
As speaker, Ikuforiji remember how dem challenge former governors Tinubu and Fashola to pass self-accounting bill and do wetin right. E talk say while people dey praise Fashola that time, di House dey always question am. E blame poverty for di country on state governors wey no dey perform, and Assemblies wey no dey question dem. On Nigeria rising debt, Ikuforiji say borrowing no bad if na for productive things, as financial institutions no dey give loan to country wey dey sink. E also mock ADC say nobody there fit stand Tinubu. Ikuforiji warn say if politicians keep jumping ship, Nigeria go turn one-party state. On Rivers crisis, e explain say president no fit remove any governor, only declare state of emergency with NASS approval. E beg say make State Assemblies wake up and hold governors accountable, like Lagos own dey do. On electoral reform, e support early elections to allow time for court cases before inauguration, and encourage Nigerians to register and vote, say boycotting election dey give way for rigging.
Written by: News Editor 2
Ikuforji Lagos speaker statement Nigerian governance issues
todayNovember 7, 2025 3
todayNovember 7, 2025 4