APC Primary Election

4 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

Desmond Elliot wash hand Comot lagos state house of Assembly

By : Jolayemi Olajide Nollywood actor wey turn politician, Desmond Elliot don comot body from APC primary election for Surulere 1 House of Assembly seat. E drop di announcement on Wednesday for Paddington Mini Stadium, Western Avenue, Surulere, Lagos, where di primary election dey happen. According to am, dem lock am outside, e beg and nobody answer am.

todayMay 20, 2026 18

OBODO NAIJA

Uzodimma Hammer Okorocha, Win APC Imo West Senatorial Ticket

By : Jolayemi Olajide Imo State Governor, Hope Uzodimma don win APC senatorial ticket for Imo West ahead of 2027 general election. Di primary election wey hold for Orlu Local Government Secretariat, show say Uzodimma defeat former governor Rochas Okorocha by big margin. Rear Admiral Williams Kayoda wey head di election committee announce say Uzodimma get 230,464 votes. Okorocha come score 1,098 votes as Uzodimma carry di ticket go next […]

todayMay 19, 2026 8

OBODO NAIJA

Okowa Floor Ned Nwoko, Grab APC Delta North Senatorial Ticket For 2027

By : Jolayemi Olajide Former Delta state  govo, Ifeanyi Okowa don win di APC senatorial ticket for Delta North ahead of 2027 general election. Okowa beat sitting senator Ned Nwoko and Dr Maryam Ali for di party primary wey hapun across di nine local government areas for di district. APC Returning Officer, Prof Johnbull Tonukari, announce say Okowa score 113,309 votes to emerge winner for di peaceful exercise. Nwoko get […]

todayMay 19, 2026 15

National

Former Foreign Minister, Tuggar Buy N50m APC Governorship Form for Bauchi

By: Esther Ayoola Former Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Maitama Tuggar, don go buy APC N50 million governorship nomination form say im wan contest 2027 election for Bauchi State. According to update by Imran Mohammed, aide to APC National Chairman Nentawe Yilwatda, Tuggar don sign documents as party officials present am di form for party secretariat. Tuggar tuk say im ambition no be to cause division but to strengthen […]

todayApril 29, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds