Bandits Kpai 11, Injure 2 for Gurbi Community for Katsina
For Katsina State, some Jaguda boys, oyinbo dey call dem suspected bandits don go attack Gurbi community for Kankara LGA, kpai eleven pipo and wunjor two others. Police spokesman Abubakar Sadiq na im dey konfamate dis mata, say once dem receive distress call, joint security team with police and military quickly move go di area. Dis attack happen around 2:40pm on April 26, 2026, as di gunmen enter di zanga, […]