African Democratic Congress (ADC) don reject one Federal High Court judgment wey order INEC to deregister dem and four other political parties.
U sabi say, Justice Peter Lifu of di Federal High Court for Abuja give di order on Monday, say di parties no meet constitutional and electoral requirements.
Di party Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, naim con sorosoke for statement to reply, post for X, say di judgment dey unconstitutional and very disturbing.
ADC talk say di ruling na attempt to use judiciary take weaken Nigeria democracy and silence opposition voices.