EPL

6 Results / Page 1 of 1

Background

Sport Yarns

Southampton Collect Ban Say Dem Spy Opponent Training Sessions

By: Esther Ayoola Southampton FC don collect punishment say dem dey spy dia opponent before match. According to independent disciplinary commission, Southampton watch training of Oxford United FC and Ipswich Town FC, and even film Middlesbrough FC before play-off semi-final. So like dis Middlesbrough go take Southampton place for championship playoff final and dem deduct dem 4 point from next season.

todayMay 20, 2026 9

Sport Yarns

Arsenal Finally Break 22-Year Jinx, Carry EPL Title

By: Esther Ayoola Arsenal Football Club don finally win di English Premier League title on Tuesday afta Manchester City draw 1-1 for Vitality Stadium. Dis na di first time for 22 years wey Arsenal go carry di Premier League trophy, afta dem don finish as runners-up for three seasons back-to-back. Manchester City bin need to win to keep di title race alive but dem fall hand beta style. Arsenal go […]

todayMay 20, 2026 9

Sport Yarns

Tottenham Drop Points For Home Draw Against Leeds, Move Closer To Relegation

By: Esther Ayoola Mathys Tel naim be hero and villain, two in one, as Tottenham draw 1-1 with Leeds for dia Monday night Premier League game. E score di first goal for second half to calm fans for Tottenham stadium, but later e cause penalty with one wrong clearance, costing dem di game. Di result mean say, Spurs future for di league dey shaky as dem just dey two points […]

todayMay 12, 2026 9

Sports

Haaland Early Goal Carry Man City Go Top of EPL Table

Erling Haaland score as Manchester City beat Burnley 1-0 for Turf Moor, take jump pass Arsenal for top of  Premier League table. Di win also confirm say Burnley don go back to Championship. Even though City try anoda 28 shots, dem no add another goal as Haaland and Cherki even hit post. Arsenal fit still return top if dem beat Newcastle, but for now na City dey lead di table.

todayApril 23, 2026 14 25

Sports

Arsenal Title Hope Dey Fade – Mikel Obi

Former Chelsea midfielder John Obi Mikel say like dis Arsenal don dey run out of ideas for Premier League title race after dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates. Di result make dem still get 6 points lead, but Manchester City don close gap with a strong 3-0 win over Chelsea. City fit even level Arsenal if dem win dia outstanding match and also beat Arsenal for dia next league […]

todayApril 15, 2026 14

Sports

Fulham 1-1 Man Utd: Iwobi Celebrate Man of the Match with Naija Food

Nigeria international Alex Iwobi celebrate him Man of the Match performance for Fulham 1-1 Premier League draw against Manchester United with taste of home, as e chop traditional Nigerian food, semo. The Super Eagles midfielder do the main thing for Craven Cottage on Sunday, as e give assist to Emile Smith Rowe first goal wey make Fulham collect one important point and stop Man United long winning run for that […]

todayAugust 25, 2025 73 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds