FCT minister

5 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Wike Tok Say Na Hin Chase Lawal Comot From PDP

By: Jolayemi Olajide FCT Minister, Nyesom Wike, don fire back at Zamfara Governor, Dauda Lawal, after e call am dat guy. Wike tok dis one on Tuesday during media parley, as e claim say na im make Lawal comot from Peoples Democratic Party, PDP. E talk say even though Lawal get money, im and im people no fit stand against am when dem still dey inside PDP.

todayOctober 13, 2026 4

OBODO NAIJA

Wike Tok Say Kwara Gofnor Dey Blame Am For Everything

By: Mariam Ajayi FCT Minister, Nyesom Wike, don tok say Kwara State Gofnor, Abdulrahman Abdulrazaq, dey always blame am for anything wey happen for im office or house. Wike talk dis one for interview with tori pipo on Tuesday, say anytime di Gofnor see snake or any kind reptile, e go say, “Na Wike.” Di FCT Minister also accuse Abdulrazaq say e dey focus more on gossip instead of doing […]

todaySeptember 16, 2026 14

OBODO NAIJA

Kingibe Accuse Wike Say E Borrow Money For FCT Without Approval

By: Mariam Ajayi FCT Senator, Ireti Kingibe, don accuse FCT Minister, Nyesom Wike, say e dey take loans for Abuja without National Assembly approval. Kingibe make di allegation on Tuesday during interview with one television station, say DMO records show say loans dey taken for FCT between August 2023 and March 2026. She add say Wike never appear before Senate to seek approval for di borrowing.

todayAugust 26, 2026 16

OBODO NAIJA

Wike Vow Say Na Only Tinubu Fit Win Rivers For 2027

By: Esther Daniel FCT Minister Nyesom Wike declare inside Abuja on Tuesday say President Bola Tinubu na di only candidate wey fit win Rivers State for di 2027 elections through one strong political coalition. Wike tell tori people say any candidate wey dey count Rivers votes dey waste time because im people don already pitch dia tent with di Presido. Di former gofnor explain di matter say politicians from PDP, […]

todayAugust 4, 2026 20

National

Wike Clear Sabi Mehn And Womehn Why Dem Need Focus On Development

By: Esther Ayoola Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike don tell professional bodies, say make dem focus more on development, instead of always criticising gornment policies. Wike yarn dis one for Abuja as e receive members of the Body of Benchers led by chairmo, Albert Akpomudje, during courtesy visit for im Life Camp residence. According to am, true leadership no be by plenty media dragging, but di legacy projects and […]

todayMay 13, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds