Heatwave

5 Results / Page 1 of 1

Background

obodo oyinbo

Europe Dey Feel Di Heat As Wildfire Spread

European Union don call for stronger action against climate change as fresh heatwave dey threaten France, Spain and other European countries with more wildfires. EU Crisis Management Commissioner, Hadja Lahbib, say Europe must invest more in climate action, forest management and disaster preparedness as global warming dey get worse. So far, more than 330,000 people don run from their homes, with about 220,000 evacuated in France and 110,000 in Spain […]

todayJuly 29, 2026 16

obodo oyinbo

Orphanage Home Catch Fire As Heatwave Scatter Algeria

According to authorities for Inside Algeria, on Thursday, at least 11 pipo, including childrensis, don kpai after serious fire burn one orphanage for Mohammadia, one area for Algeria capital, Algiers. Dis badness happen as di country dey battle severe heatwave wey don cause hundreds of fire outbreaks. According to one resident, Abdessalam Merrah, he talk say around 3 a.m. dem hear fire engines and childrensis wey dey scream inside di […]

todayJuly 16, 2026 12

obodo oyinbo

Heatwave Kpai 2,700 People for England, Wales

By : Jolayemi Olajide Person wey dey naija, and other part nor knw wetin God do for am, say like dis, at least 2,700 pipo kpai for England and Wales because of serious heatwaves wey hapun for May and June. According to research wey dem package for Imperial College London, heat wave don make pipo get igbeke, na so dia body dey red, u knw oyinbo na, e be like […]

todayJuly 13, 2026 11

obodo oyinbo

Portugal Enter Emergency Mode As Heatwave Worsen

Portugal weather agency, wey dem dey call IPMA, don put  Lisbon and Setubal regions for red alert on Thursday because of dangerous heatwave wey dey spread across di kontri, while Leiria and Coimbra go join di alert on Friday. IPMA tok say temperature fit reach 44 degrees Celsius for some northern areas, while Evora and three oda inland regions don already enter orange alert on Wednesday as Europe dey battle […]

todayJuly 2, 2026 13

obodo oyinbo

Heatwave Kill Over 1,000 People For Spain

More than 1,000 pipo don kpai for Spain because of di recent heatwave wey roast Europe. Spain Carlos III Health Institute konfam dat at least 1,028 pipo naim don kpai from heat-related sickness during di extreme hot weather. Di death figure double di 407 deaths wey Spain record for June 2025, wey bin be di hottest June before. Weather agency Aemet also confirm say di first six months of 2026 […]

todayJuly 1, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds