obodo oyinbo

Heatwave Kill Over 1,000 People For Spain

todayJuly 1, 2026 8

Background
share close

More than 1,000 pipo don kpai for Spain because of di recent heatwave wey roast Europe.

Spain Carlos III Health Institute konfam dat at least 1,028 pipo naim don kpai from heat-related sickness during di extreme hot weather.

Di death figure double di 407 deaths wey Spain record for June 2025, wey bin be di hottest June before.

Weather agency Aemet also confirm say di first six months of 2026 na the hottest ever for Spain, with temperature averaging 1.6 degrees Celsius above normal.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds