INSECURITY

21 Results / Page 2 of 3

Background

south west

 Oyo Lockdown! Gov. Makinde Impose 16-Hour Curfew For 10 Local Government Areas

By : Jolayemi Olajide Security wahala don reach boiling point for Oyo State as Governor Seyi Makinde don officially declare 16-hour curfew for 10 local government areas wey dey border di Old Oyo National Park. Di new order, wey start today, Wednesday, June 24, 2026, mean say nobody suppose dey outside between 4:00 p.m. and 8:00 a.m. The curfew go last for at least 48 hours as security agencies intensify […]

todayJune 24, 2026 27

south west

Protesters Block Ibadan Iwo Road, Demand Release of Kidnapped Schoolchildren

By: Jolayemi Olajide Motorists and passengers wey dey use Iwo Road interchange for Ibadan suffer heavy traffic on Monday as dem protest block di busy road and scata movement for di area. Di protesters, under di Take It Back Movement, gather for di junction around 10 a.m. to demand make authorities release di Oyo schoolchildren and teachers wey kidnappers carry go. Di protest cause serious go slow as many commuters […]

todayJune 22, 2026 17

National

Late General Rabe Family Kwanta with Kastina State Gorment

Con see problem oh, as pikin of late Major General, Rabe Abubakar (rtd), Isyaka Rabe,  don reject claim wey Katsina State Gornment tuk say im papa die from diabetes and hypertension. Im talk dis one for interview with news pipo, say kastina state gorment report nor correct, as im papa no get history of diabetes. Isyaka add say some pipo dey even tuk say na snake bite or heart attack, […]

todayJune 15, 2026 21 2

OBODO NAIJA

Oyo APC Blast Makinde Over Kidnap, Killing and Security Wahala for State

By : Jolayemi Olajide Di Oyo State chapter of di All Progressives Congress (APC) don cry out again over di regular kidnapping, killing, and fight-fight wey dey hapun without any break  for di state. Inside one statement wey di party Publicity Secretary, Olawale Sadare, release for Ibadan, APC talk say things dey go wrong sake of say di govo Seyi Makinde l dey do eye-service and politics with security. Di […]

todayMay 29, 2026 20

National

Army Chief Order Troops Make Dem Flush Out Bandits and Kidnappers for Kwara  

Wi Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu don order troops of Joint Task Force North Central, Operation Savannah Shield, dat make dem stop all di okporkpise doings by terrorists, bandits, kidnappers and other criminals wey dey operate for Kwara State and neighbouring states. Di Army Chief give di order during im first operational visit to di headquarters of the task force for Sobi Barracks, Ilorin. Oga Waidi Press […]

todayMay 29, 2026 16

OBODO NAIJA

How Oga Presido Tinubu Dey Get Sleepless Night Because of Insecurity

Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris,  say like dis, wi oga  Presido Bola Tinubu dey work harder now to join hand with other countries make dem fit stop insecurity for Nigeria. Idris yarn dis one to journalists after im meet di President for Lagos on Sunday. Im talk say Tinubu dey reach out to neighbouring countries and international partners to fight problems like terrorism wey don scatta […]

todayApril 6, 2026 30

OBODO NAIJA

How Women Form Vigilante Team For Plateau State

Some group of women based on gbege for area for Jos don form vigilante group as jaguda boys no allow dem drink water keep cup dey patrol streets for night. Di group oga, Blessing Ngozi Emmanuel, ni yan pipo dis update on Wednesday, on how e take dey do dem for di Jos. She press tuks on how both Christian and Muslim women take dey do collabo, sacrifice dia comfort […]

todayMarch 26, 2026 29

OBODO NAIJA

Navy, Police Join Hand, Vow To Rascal Insecurity

Nigeria Navy and Police don agree say dem go work closer together to fight security wahala wey dey grow for country. Na for one join bodi meeting  for Abuja, Police oga Olatunji Disu meet Navy boss Idi Abbas, yarn dis one Di Navy promise say dem go continue to support joint operations and even train Marine Police for dia facilities. Oga IGP thank di Navy for dia support, especially for […]

todayMarch 26, 2026 18

National

Bandits Kpai Over 30 People For Katsina And Kwara

By: Esther Ayoola For Katsina and Kwara states, say bandits don kpai kpai more than 30 pipo for different villages on Tuesday. For Katsina, di Doma community for Tafoki Ward, Faskari Local Government Area, na at least 20 people dem kill. Dem burn house and motor, make pipo throway leg run for dia life. Faskari Local Gornment Chairmo, Surajo Aliyu, tuk say na revenge attack and na di worst wey […]

todayFebruary 4, 2026 21 641

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds