By: Jolayemi Olajide
Motorists and passengers wey dey use Iwo Road interchange for Ibadan suffer heavy traffic on Monday as dem protest block di busy road and scata movement for di area.
Di protesters, under di Take It Back Movement, gather for di junction around 10 a.m. to demand make authorities release di Oyo schoolchildren and teachers wey kidnappers carry go.
Di protest cause serious go slow as many commuters and business owners struggle to continue dia daily activities.