SANWO OLU

25 Results / Page 2 of 3

Background

Lagos

Lagos Collobi ₦1.3 Trillion From Tax For 2024 – Govo Sanwo Olu

Governor Babajide Sanwo-Olu share update say Lagos State don make about ₦1.3 trillion as internally generated revenue for 2024. Im yan dis one as e speak on Wednesday for opening of 159th Joint Revenue Board meeting for Lagos. Sanwo Olu explain say di money growing na based on gornment investing for digital tax system and expand how dem take collect tax across di state.

todayApril 23, 2026 26

Lagos

Lagos Gorment Ban Manual Building Permit, Move Everything Go Computer

Lagos State Gornment don officially stop all manual way of processing house planning permit,  moving everything to computer. Special Adviser Olajide Abiodun dey yarn dis one for statement wey dem release on Tuesday, say na new era under Governor Babajide Olusola Sanwo-Olu. E talk say dem don fully prepare, train workers, and set up computers and internet for all offices, so like dis di  system don ready to run. Say […]

todayApril 14, 2026 32

Lagos

Governor Sanwo-Olu Enter 50-Year Property Agreement With Ikoyi-Property Owners

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu don approve 50-year rent package for pipo wey get property for Ikoyi-Obalende area. Di announcement come out through im special adviser on e-GIS and Urban Development, Olajide Babatunde, during one stakeholders meeting wey hapun for Ikoyi. Babatunde clear matas say dis approval na result of plenty years of discussion between Lagos State gornment and Obalende residents about di future of di community.

todayApril 6, 2026 28

Lagos

Presido Tinubu Land Lagos To Celebrate Easter And Open Projects

Wi oga Presido Bola Tinubu don enter Lagos for easter celebration after im go condole victims of di Angwan Rukuba attack. Tinubu arrive airport around 7:20 p.m., where Lagos State Govo Babajide Sanwo-Olu and other top officials receive am. People wey see am tuk say Tinubu go celebrate Easter and also inaugurate some gornment projects for di state.

todayApril 3, 2026 22

Lagos

Lagos State Govo Sanwo Olu Celebrate Oga Presido At 74

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu hail Bola Ahmed Tinubu as e celebrate im 74th birthday, call am korect leader wey get vision and love for kontri man and woman Sanwo-Olu praise Tinubu, call am patriotic and caring leader wey don help bring growth and development to Nigeria. For statement wey im media aide Gboyega Akosile release, di governor say Tinubu leadership don help renew people trust for government. Im still […]

todayMarch 29, 2026 23

Lagos

Oga Govo, Sanwo-Olu Open Irele Towers As Lagos Free Trade Zone

Govo, Babajide Sanwo-Olu don open one new ogbonge free commercial building wey dem dey call Irele Towers for Lagos Free Trade Zone. For di ogbonge lunching on Thursday, baba govo say dis building go hellep boost Lagos economy, create jobs, and attract investors. Di govo thank private investors wey join hand to develop di project, explain say e go give businesses easy access to ports and other important infrastructure. Sanwo-Olu […]

todayMarch 27, 2026 20

Lagos

Sanwo-Olu Explain How Im Dey Package Lagos For International Business

By: Esther Ayoola Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don go arrange package, unveil Lagos International Financial Centre (LIFC) with plans to make Lagos economy strong. E beg both gornment and private sector make dem continue to joinbodi to make Lagos become global financial hub. Sanwo Olu say, LIFC, wey dem start plan two years ago, go bring international money, grow financial market, and create better work chance for pipo.

todayFebruary 6, 2026 27

Local

Lagos Assembly Tell Sanwo-Olu Make E Arrange Plan for Local Gov’t Lawmakers to Get Money Power

Lagos State House of Assembly on Tuesday don call on top Governor Babajide Sanwo-Olu make e provide better plan wey go allow local government councils manage their own money. Dis move na to make democracy strong for grassroots level by giving councillors financial independence from local government chairmen wey be di executive arm. Di resolution, wey Hon. Sani Okanlawon lead, show say di current arrangement wey local government lawmakers dey […]

todaySeptember 17, 2025 43

Lagos

Sanwo-Olu Unblock Lawyer For X As Wahala Of Court Case Still Dey Hot

Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State don unblock di human rights lawyer, Festus Ogun, wey sue am because say e block am for X. Na di Special Adviser on Media and Publicity to di Governor, Gboyega Akosile, yarn dis one on Saturday for im official X account. “Governor Babajide Sanwo-Olu don show leadership again as e invite citizen wey sue am because say e block am for X,” na wetin […]

todaySeptember 15, 2025 39

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds