By: Mariam Ajayi
Nor be small jogolo for Germany, dat dia heatwave don kpai kpai pipo full ground, dat like dis nothing less dan 14,000 pipo naim don kpai dis summer alomng
According to public health officials, Di Robert Koch Institute say about 9,600 pipo kpai within one week for late June when temperature pass 40 degrees Celsius.
Di institute say people wey dey above 75 years make up di biggest number of di deaths, while heat fit make existing sickness worse and cause death.
Di figure pass Germany 2018 record of about 8,900 heat-related deaths, with officials saying di difference na because some years get hotter heatwaves than others.