By : Jolayemi Olajide
Nigerian sprint queen Tobi Amusan don win Nigeria first gold medal for Senior Athletic Championships wey dey hapun for Accra on Wednesday.
She outrun every other person for women 100m hurdles, while her fellow Nigerian Adaobi Tabugbo carry bronze medal for di same race.
Na di third African Championships gold medal be this for Amusan, and Sebastian Coe personally hand am the medal.
Before di race, Amusan tell young athletes make dem no allow fear stop dem from chasing their dreams.