By Ebi Oboko
Unto joliment marras for Lagos, say Sixteen top African artistes don land di obodo Naija as Lagos State dey host the 9th edition of All Africa Music Awards, AFRIMA, say di mata sef go run for one week.
Dis event start from Wednesday January 7 and go end on Sunday January 11, with big Owambe pari on Friday for Ikeja and the main awards night for Victoria Island.
Di Lagos State Gornment don put vow for ground say dem dey ready to work using entertainment and culture take drive development and boost the economy.
based on capings with tori pipo before di event, Commissioner for Tourism, Arts and Culture, Toke Benson-Awoyinka, say AFRIMA na one strong platform wia dem dey celebrate African music and show Africa creativity to the world.