By: Kofoworola Olayinka
A 55-year-old driver escape injury after train ran im Honda car for PWD railway crossing for Lagos as di vehicle suffer heavy damage.
Di Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, say im officials and security personnel rescue di driver and clear di damaged car from di railway track.
Di agency say di train wey dey head towards Agege continue im journey after dem clear di track, but traffic congestion still dey around PWD area.
LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki, warn motorists to dey careful for railway crossings and avoid crossing when train dey approach or dey move, as di damaged car don hand over to security personnel for investigation.