By: Esther Ayoola
US Presido, Donald Trump don tuk say e go suspend federal gasoline tax as petrol price go higher sake of Iran war.
E tuk dis one for White House as im bin dey chest some questions from tori pipo, say di suspension go continue till everybody balance demself.
Di tax wey dem wan pause dey around 18.4 cents per gallon for gasoline and 24.4 cents for diesel.
However, di koko be say, dem go sti need Congress approval before dem fit fully carry out di reduction.