Senior man Presido of America, Donald Trump don open case and plan to sack hin pikin former girlfriend, wey be US ambassador to Greece, Kimberly Guilfoyle, based on say she bin use back door clear her loans.
As tori pipu ask Trump wetin hin go do to hin first pikin Donald Trump Jr former fiancee, senior man squeeze face, tok say make dem leave di mata to am, say hand go touch her, if dem find her guilty.
All dis wahala start based on Wall Street Journal aproko news, with screenshot proof, say di former Fox News presenter bin dey beg one big Trump supporter make e clear her $100,000 credit card debt.