By: Yusuf Abuh
Trump gornment don talk say US don go 15 months without releasing any illegal migrant into di country, as dem claim say dem don send over 3 million migrants comot.
US Department of State say dis move na to tighten immigration rules, put Americans first and fix wetin dem call serious immigration wahala wey happun under former Presido Joe Biden.
Di gornment say thousands of di migrants wey dem don send comot get conviction for serious violent crimes, while dem also dey chase people wey use fraud take collect US citizenship.
So far, dem say dem don file cases against 88 people wey investigation show say dem no qualify to hold US citizenship.