Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Presido Donald Trump of di United States don withdraw Canada invitation to join im newly launched Board of Peace.
Di move happen hours afta Trump formally unveil di board and days afta Canadian Prime Minister Mark Carney deliver speech for World Economic Forum, Davos 2026.
For him speech, Carney praise middle powers and criticize powerful countries wey dey use economic integration as tool of coercion.
According to report, Trump decision sef na based on wetin Carney tuk for Davos wey nor sweet am, and dis mata don dey spark global reaction.
Written by: News Author
Board of Peace Canada removed from board DONALD TRUMP US foreign policy
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025