Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
U.S. Presido, Donald Trump don promise to hit Iran “twenty times harder” if dem block oil tankers for Strait of Hormuz. and say di war go end “very soon.”
Meanwhile Plenty pipo gather for Iran dey show support for new Supreme Leader Mojtaba Khamenei, say na im go decide wen di war go end, not be US.
Iran sti dey fire back Israel and US properties for Middle East, like for Bahrain, Kuwait and Saudi Arabia, and at least two pipo don kpai for Israel.
For Lebanon, Israel and Hezbollah dey exchange fire, and death number from Israeli attack don pass 486 people.
Written by: News Author
Global oil supply threat Strait of Hormuz oil crisis Trump warns Iran US Iran tensions
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026