obodo oyinbo

U.S Presido Trump Say Iran Dey Feel Di Heat

todayMarch 6, 2026 4

Background
share close

US Presido, Donald Trump  say Iran don dey feel di heat oh,  reach say, Iran no get air force again.

Trump put for im Truth social say, i tuk am, an dem don dey see workings for Iran.

Meanwhile for Iran, Secretary Ali Larijani dey rake say Iran soldiers dey ready if US come ground fight, dem fit kill and capture plenty Americans.

Since Saturday, US and Israeli attacks don kpai at least 1,230 pipo for Iran, two schools for Parand near Tehran don also collect  missile.

Iran still dey attack Gulf countries like UAE, Qatar, and Bahrain, while Israel Tel Aviv face drone and missile attack for Thursday night.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app