By: Rilwan Agbomeji
United Nation Security Council don hold emergency meeting, say di kpai kpai, wey pipo dey kpai for Iran protest dem nor like am at all, at all.
You sabi say, US Presido Donald Trump sti tuk for dis mata, even threaten to use military for di country.
Iran UN deputy envoy talk say Iran no wan fight, but dem go respond if US start wahala, and accuse US say e dey cause di unrest.
For im speech for di UN meeting, US rep Mike Waltz drag wetin nor good from Iran gorment, say di intenet sef nor dey carry di real tin wey dey hapun for Iran and dat di people dey demand freedom like never before.