OBODO NAIJA

Wike Defend Why Im Buy Waka Go see APC Chairmo

todayMay 13, 2026 2

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

FCT Minister, Nyesom Wike, don dismiss all di yanyanpu say im go visit to APC National Chairmo, Prof. Nentawe Yilwatda, saying dat, im no dey practise “politics of enmity.”

Wike tuk dis one Wednesday during inspection of road projects for Karu, Apo-Karshi and Kubwa, saying pipo misunderstand wetin be ordinary visit between former ministerial colleagues.

According to am, because dem don work together before, e no see any reason to avoid or hide from Yilwatda just because of political differences.

Im insist say im private relationships no be anybody business and e no owe anybody explanation over who e choose to associate with.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds