By: Ayobami Dada
FCT Minister, Nyesom Wike, don tok am again ooo, say im number one political target now na to make sure say President Bola Ahmed Tinubu win di 2027 presidential election.
Wike talk dis on Monday for Abuja after e inspect some ongoing road projects across di Federal Capital Territory (Abuja).
E also deny some kind tok say di Rainbow Coalition wey e dey part of na plan to scatter political parties, say that kind tok no hold water at all.
Wike say di coalition na to bring pipu from different political parties wey support Tinubu government together, adding say im immediate concern na 2027 election and to make sure Tinubu government continue after 2027.