OBODO NAIJA

World Bank Approve $500m Credit Giv Nigeria Agricultural Value Chains.

todayApril 2, 2026 7

Background
share close

World Bank don approve $500 million credit give Nigeria to boost agriculture, especially for small farmers, value chains and food security.

For statement wey World Bank drop for their website on Thursday, dem talk say di money go make small farmers produce more, create jobs, and make food and nutrition better for di Obodo Nigeria.

Di global lender talk say agriculture still be Nigeria biggest employer, but e never dey show better workings sake of say gbege dey for di system.

Dem say di project go focus on gathering crops, handling dem after harvest, agro-processing, and make market wahala easy, say di main focus dey on rice, maize, cassava, and soybeans.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app