Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State House of Assembly don talk say dem no go fold hand watch as serious chieftaincy gbege dey scatter the Onikoyi Royal Family, dem say dem go step in sharp-sharp. This one happen after members of the royal family storm Assembly gate yesterday with peaceful protest, beg lawmakers and the state government make dem stop the alleged “one-sided” installation of a new king. Hon. Rauf Age-Suleiman, wey dey represent Amuwo-Odofin Constituency 2, yarn with say make nobody worry, dem go act fast. “We dey hail una for doing peaceful protest, better pass to carry cutlass or gun. Una don drop una matter, the House go sit down, break am down, and we go get back to una,” na so e talk. Di family talk say Prince Kunle Fafunwa don dey wear crown as new Onikoyi of Ikoyi and Imoba land, but dem say na Lagos State Government force am enter without following the traditional rotation between the 10 ruling houses. Di ruling houses na: Fafunwa, Ojubiari, Ikubayije, Ikugbamola, Ilumo, Dosunmu Ajiwe, Idewu, Adelo and Dosunmu. Dem still yan say Prince Fafunwa na pikin of the last king, but tradition no dey allow one family hold the throne back-to-back like say na inheritance. For the petition wey the Olori-Ebi, Otunba Onikoyi, sign, dem shout say make government respect the old royal law wey guide who go wear crown next, because culture no be play. “Our family get rich heritage wey follow clear structure and tradition. We no dey run things anyhow, and that law must stand to protect the unity of our kingdom,” na wetin the family yarn. Dem point government to the Onikoyi Royal Family Declaration of 2006, wey dey inside Lagos State Official Gazette. That document talk am clean, Ojubiari Branch na the next in line for the throne, and na dem get full right to produce the next Onikoyi. Dem no stop there, the family warn say Fafunwa Branch, wey just install Prince Kunle (son of the last king), no get legal right to continue in power. According to them, this move break the law wey Lagos State itself recognise. “This kain shortcut dey scatter long-standing tradition and fit tear our kingdom apart. Make dem no turn our crown to family inheritance, rules dey and dem must follow am,” the statement warn.
“We dey beg di Assembly, together with all di people for Lagos State Government and everybody wey concern, make una respect di lineage and wetin dey for di Onikoyi Chieftaincy Declaration of 2006, wey then State Governor, Bola Tinubu, wey be President of Nigeria now sign as customary law. To make sure say correct and rightful person enter throne no be just to follow rules anyhow; na to respect our heritage and di leadership legacy wey dem hand over to us. Di future of Onikoyi Kingdom depend on how all of us go take hold this tradition tight and follow am with clear mind. We dey beg make una help us settle this mata well, make di right person enter throne and make our royal family dey united again,” na so dem take beg.
Written by: News Editor 1
CHIEFTAINCY ISSUES LAGOS ASSEMBLY ONIKOYI ROYALTY
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025