By: Esther Ayoola
Di Federal Government on Tuesday order immediate palliative repair work for Lagos–Ota–Abeokuta Road to fix serious damage and restore free traffic movement.
Minister of Works, Dave Umahi, give di directive when e inspect di federal highway wey link Lagos State and Ogun State.
Umahi explain say dem assess about 22 kilometres of di road, but repair work go focus on about 18 kilometres wey don bad well-well.
E add say di government already dey handle about 60 kilometres along di corridor, and dem dey carry out di construction in phases based on urgency to reduce traffic wahala.