By: Esther Ayoola
Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don on Monday sign ₦4.4 trillion 2026 budget into law for di state.
E run di parrol for Conference Room, Lagos House, Alausa Secretariat, Ikeja.
Oga Govo say di budget, wey dem call “Budget of Shared Prosperity,” go help improve life for people and support development across Lagos.
U sabi says, Di Lagos State House of Assembly bin pass di bill earlier for January, and dem approve say make dem issue and spend ₦4,.4 trillion for 2026 fiscal year.