By: Esther Ayoola
Seyi Makinde Disciples don dey beg members wey dey follow Minister Nyesom Wike an im caretaker committee make dem return back for Pipos Democratic Party leadership.
Leader of di disciples , Laja Adeoye, ni dey drop dis one for interview for Lagos, say di party dey ready for reconciliation.
E call on Mohammed Abdurahman, Sen. Samuel Nwanyanwu and dia team make dem embrace peace, come join di party structure wey constitution recognise.
Adeoye also yarn say, Court of Appeal for Ibadan don advice leaders to continue tuking an settle di party wahala.