Dis one dey inside statement wey Hamisu Muhammad Gumel, Chief Press Secretary to Jigawa governor, release give media tori pipo.
Di Governor talk dis one during Eid-el-Fitr celebration for Dutse, after e receive Emir of Dutse and other traditional oga dem for Hawan Bariki Durbar on Saturday.
According to am, di situation no sweet oga presido belle and e don start move to make things easy, including plan to reduce transport cost across di country.
E add say recent increase for fuel price, wey connect to happenings for Middle East, don put more pressure on Nigerians, especially for transport and cost of living.