By: Esther Ayoola
Di Federal Capital Territory (FCT) Minister, Nyesom Wike-backed National Caretaker Working Committee (NCWC) of di Peoples Democratic Party (PDP), don ask party members make dem no mind any wahala or misleading tori wey dey about di party leadership.
Di NCWC National Publicity Secretary, Jungudo Mohammed, tuk dis one for Abuja on Sunday as dem dey yarn about wetin dey hapun for di party leadership and di coming national convention.
Mohammed say Federal High Court and Appeal Court don confirm say NCWC get di correct authority to run di PDP affairs.
E add say di court ruling na final, e dey bind everybody, and e sti dey fully valid.