OBODO NAIJA

House of Rep Pass N68.3 Trillion 2026 Budget

todayApril 1, 2026 13

Background
share close

House of Representatives for Abuja don pass di 2026 Appropriation Bill wey go spend N68.3 trillion.

According to House Leader Prof. Julius Ihonvbere, say dis budget go favourĀ  development more dan consumption and make capital spending pass recurrent spending for di first time.

U sabi say, di approved budget, wey Presido Bola Tinubu propose last year, include over N26 trillion for roads, power, and other projects, N5.4 trillion for security, and N15.9 trillion to pay debt.

Speaker of di House, Rt. Hon. Tajudeen Abbas, add say lawmakers follow korrect process, pass am on time so datĀ  Nigeria fit keep di January-to-December budget cycle.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds